Wen Fero free di pipol, God nor take dem pass Filistia pipol land even doh, na dat side near pass, bikos God sey, “Make di pipol nor go shange dia mind wen dem si war kon sey, ‘Wi won go back to Egypt.’ ”
So Moses tell di pipol, “Make una remember today wey una komot from Egypt where una for bi slave. Dis na di day wey di Oga una God take una komot with en great pawa. So make nobody chop bread wey get yist.
Dis go bi like sign wey una put for una hand and fore head, so dat Oga God law go dey una mout, bikos na with en strong hand E take karry una komot Egypt.