2 Make una raiz una hand for di temple kon praiz God!
Ezra kon sey, “Make wi praiz di Oga wey bi di great God!” All di pipol raiz dia hand go up kon ansa, “Amen! Amen!” Dem knee down, bow and woship God.
Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu and di hand wey I take dey praiz Yu, asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.
My God, I dey live my life well, so dat I go fit kom yor altar
Make Yu listin to my prayer for mesi as I dey kry to Yu for help and as I lift up my hand for yor holy temple.
I don si Yu for di temple kon si yor mighty pawa and glory.
I go praiz Yu as long as I dey dis life and I go raiz my hand kon pray give Yu.
Just as meat dey satisfy pesin na so too Yu satisfy my soul. So my mout go always dey praiz Yu
Wake-up for nite, make yu kry. Pour all yor heart like wota before God! Raiz yor hand as yu dey pray to am and dey beg for yor shidren wey dey faint, bikos honga won kill dem.
Make wi lift awa hand and heart to God for heaven kon sey,
So, I wont make evribody dey pray for evriwhere, dey raiz dia holy hand without vexnashon or kworel.