“Go tell evribody for Jerusalem sey: ‘God sey, “I remember as una dey faithful wen una dey yong. Una bin love mi well-well like woman wey just marry; una follow mi waka for wildaness and for dry land.
Dem karry Judah pipol go Babilon as slave kon dey sofa dem. Na anoda land dem dey stay and dem nor get peace at-all. Even with di pain wey dem dey pass thru, evribody wey porshu dem, katch and ponish dem.
I go gi-am back en vineyard den Trobol Valley go kon bi Hope Valley. E go ansa mi for der, just as e do wen e dey yong for di time wen e dey komot from Egypt.