Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 126:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Wen God take wi en pipol go back to Zion from Babilon, E bi like sey wi dey dream!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 126:1
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Afta Job don pray for en friends, God kon make am rish for evry side again and E gi-am taims-tu of evritin wey e lost.


Even if I koll am and E ansa mi, I nor go bilive sey E dey listin to wetin I dey tok.


Wen I dey face trobol, I kry to God and E ansa my prayer.


I go look up to di mountin! Where my help from dey kom?


I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”


My God wey dey heaven, na Yu I dey depend on.


Make Israel pipol sey, “If to sey Oga God nor dey awa side?”


Pipol wey trust God dey sikure like Mount Zion; nobody go fit bend dem and dem go dey forever.


E go from Zion kon save Israel pipol! So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.


Na who go kom from Mount Zion kon save Israel pipol? Wen God don save en pipol, den Jakob shidren go shaut with joy and Israel pipol go happy well-well.


My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land and give Israel en glory back.


Yu forgive yor pipol dia sins. Yes! Yu kover all dia sins.


Yes! I sey, una go find mi and I go bring una kom back to una land. I go gada una from evry kountry and place wey I skata una go and I go bring una kom back to di land wey I from send una go Babilon. Mi, wey bi God, don tok.’


Since I don do dis tin, I go keep my kovenant with my savant Jakob and David shidren-shidren. I go choose one of David shidren-shidren make e rule ova Abraham, Isaak and Jakob shidren-shidren. I go sorry for my pipol kon make dem prosper again.”


As for una Judah pipol, I don set time wen I go take ponish una bikos of una sins, even doh sey I go make my pipol prosper again.”


“For dat time, wen I don make Judah and Jerusalem prosper again,


Wen dem hear sey Jesus don wake-up from deat and Mary Magdalin don si-am, dem nor bilive.


But dia word nor mean anytin to di apostles, so dem nor bilive di wimen.


And as dem neva still bilive (bikos of dia happiness) and still dey sopraiz, Jesus ask dem, “Una get anytin to chop for here?”


Pita follow am go outside. Even doh e bilive sey wetin dey happen so na true, e tink sey na dream e dey dream.


den di Oga una God go sorry for una. E go bring una kom back from di kountries wey E bin skata una go kon make una prosper again.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ