Di pipol leaders kon dey stay for di holy town for Jerusalem and if dem divide di pipol for Judah and Benjamin town into ten, na one part dey stay der, while di rest dey stay where dem dey before.
E give Hatak one kopy for di kommand wey dem read for Shushan, sey make dem kill all Jew pipol. Mordekai sey make e go give and tell Estha evritin, so dat e go beg di king make e sorry for en pipol.
“So make una happy with Jerusalem; all of una wey like dis town, make una happy for am! All of una wey bin dey mourn for am, make una happy with am naw!
God tell en pipol wey dey Babilon, “Una don eskape deat! So make una dey go and nor wait! Even doh una dey far from una land, make una tink about mi wey bi una Oga God and una go remember Jerusalem.”
Di nashon bi like strong lion; wen e dey sleep, nobody fit wake am. Anybody wey bless Israel pipol, go dey bless and anybody wey curse Israel pipol, curse go follow am.’ ”
Papa, I dey pray, so dat all of dem go get one mind, just as mi and yu bi one. I still dey pray make dem dey with us, so dat di world go bilive sey na yu send mi.