Wen Ahitofel si sey dem nor follow en advise, e enter en donkey go en own town. Wen e don setol all en matter, e kon hang ensef. Dem beri am for dia family grave.
But as I sidan dey tink of evritin wey I don do, I si sey all of dem dey yuzles. Dem bi like wen pesin dey porshu breeze! E nor really get anytin wey pesin fit gain for dis world.
E stand kon shaut for Israel pipol, “Wetin una dey do for der? Make una kom out kon fight? I bi Filistia pesin and una na Saul savants. Make una choose one of una man make e kon fight mi.