82 My eye just dey look to si sey wetin Yu promise, dey happen. So wen Yu go kom help mi?
I don taya to look, to si weda Yu go kom save mi; so dat evritin go bi just as Yu promise mi.
I don taya to dey shaut for help; sore dey my trot naw and my eye don taya to dey look for my God.
Make Yu show mi sign sey Yu go favor mi. Den shame go katch di pipol wey hate mi, bikos Yu wey bi my God, don help and konfort mi.
Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick, but dream wey kom to pass, bi like tree wey dey give life.
I bin tink sey, I nor go ever si God or anybody wey dey alive again for dis world.
I don kry sotey wota nor gri kom out from my eye again; my heart don break. I don taya and e dey pain bi wen I si how dem distroy my pipol and how shidren dey faint anyhow for di town.
God go give una shidren to oda pipol and even as una dey look dis tins, una nor go get pawa to do anytin.