81 I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
I go si am with my eye and E nor go bi anoda pesin at-all.
Na Yu bi my proteshon and guide and na yor word dey give mi hope.
I always dey happy to dey learn yor rules and laws.
I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well.
My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail and di salvashon wey Yu promise mi.
Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi, bikos I trust yor word.
Make Yu nor take yor word komot from my mout, bikos na yor law dey give mi hope!
Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.
Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
So, I put my hope for God hand, I trust am with my whole life and I dey wait for en word wey nor dey fail.
My body fit fail and my spirit fit weak, but na God dey make my heart strong; na-im bi my own forever.
I really love to dey di kourt wey dey God temple. My heart and my whole body dey shaut for joy, bikos of God wey dey alive.
So Jerusalem wimen, make una promise mi sey: If una si my love, una go help mi tell am sey, en love don make mi dey sick.