78 Make Yu disgrace doz wiked pipol wey dey lie for my head; but I go always dey follow yor kommand.
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.
I go learn yor kommand kon study yor laws.
Yu porshu sturbon pipol; doz wey nor dey obey yor kommand and bikos of dis, curse dey dia head.
Even doh important pipol sidan dey plan against mi, I go still dey tink of yor kommand,
Na so-so laf wiked pipol dey laf mi, yet, I dey still obey yor laws.
Nobody wey trust Yu dey si disgrace, but disgrace na for doz wey dey try to deceive odas.
Make disgrace and shame follow pipol wey dey happy sey I dey sofa. Make nobody honor doz wey dey dance, bikos I dey sofa and make shame kover dem.
bikos I nor do dem any bad tin, but dem dey set trap and dig pit to katch mi.
Pipol wey just hate mi wen e bi sey I nor do dem anytin, many pass di hair wey dey my head. Doz my enemies wey won distroy mi without any rizin, too plenty to kount. Dem dey make mi pay for wetin I nor tif!
Nashon wey dey karry body up, go fall skata and nobody go help am. I go set fire for una town kon distroy evritin.”
All dis tins happen, so dat wetin God law tok, go bi true sey, ‘Dem nor get rizin to take hate mi.’
But why pipol go praiz yu wen dem ponish yu bikos of wetin yu do and yu bear-am? But if yu sofa bikos yu do good, God go favor yu,
E kon tell David, “Yu betta pass mi, bikos since I know yu, yu dey good to mi, even doh I dey try to kill yu.
David still sey, “Wetin make my oga di king dey porshu en savant? Wetin I do? Wish bad tin I do?