77 Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
I go obey yor laws and I nor go forget yor word.
Make Yu dey good to mi wey bi yor savant, so dat I go live and obey yor word.
My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise.
My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail and di salvashon wey Yu promise mi.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
Abeg, God make Yu sorry for Jerusalem town wey Yu choose, nor bi bikos wi deserve am, but bikos of yor great love wey nor dey fail.