74 Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.
As God holy rish, E kon promise sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley.
I dey wake-up before day break well and yor words dey give mi hope.
Den I go fit ansa pipol wey dey won kill mi, bikos I trust yor word.
Make Yu nor take yor word komot from my mout, bikos na yor law dey give mi hope!
Make Yu add mi join di pipol wey dey fear Yu; doz wey know yor laws.
Kom! All of una wey dey loyal to God, make una listin as I dey tok wetin E do for mi!
Den di pipol wey dey fear God kon tok to each oda and God listin and hear wetin dem tok. For God present, all doz wey dey fear and respet en name, dem kon rite dia name put for one book so dat God go remember dem.
Heaven and eart go vanish komot, but my word go dey forever.