Hiram still sey, “Na di Oga God for Israel deserve all di praiz, bikos na-im make di sky and di eart! E don give David one pikin wey wise and undastand sey e suppose build temple for God, plus royal palis for ensef.
Wi know sey God Pikin don kom and e don give us sense to know di trut about God. And wi dey inside en Pikin Jesus Christ. Na-im bi di real God and na-im bi di life wey nor go end.