7 As I dey learn evritin about yor raitiousness, I go tank Yu as I dey live my life as I suppose to live am!
My God, I go praiz Yu, so make Yu tish mi yor laws.
I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail kon tish mi yor laws.
Make praiz dey always kom out from my mout, bikos Yu don tish mi yor laws.
Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
My God, yor love wey nor dey fail, full di world; so make Yu tish us yor laws!
Na Yu make and kreate mi. Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand.
Make Yu tish mi to do wetin Yu wont, bikos Yu bi my God and make yor Holy Spirit guide mi as I dey waka.
My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
God wey save una, di Pesin wey dey holy for Israel, dis na wetin E tok: ‘Na mi bi di Oga una God, di Pesin wey dey tish una wetin dey good. Di One wey dey show una di road wey una go follow.
Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi.