Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:63 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

63 Na pipol wey dey fear Yu bi my friends; doz wey dey obey yor kommand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:63
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go favor di good pipol wey dey di land and dem go kom stay with mi. Na only doz wey nobody dey tok bad about, go serve mi.


Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die.


Make Yu add mi join di pipol wey dey fear Yu; doz wey know yor laws.


Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.”


Bring mi kom out from prison, so dat I go tank Yu. Pipol wey dey fear God go kom gada round mi, bikos Yu dey good to mi.”


Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass! I dey happy to si and listin to dem.


Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.


Na wetin wi don si and hear, wi dey tell una, so dat una go fit bi awa friend, just as wi bi friend with di Papa and en Pikin.)


Wi know sey wi don cross from deat enter life, bikos wi dey love and kare for awa brodas and sistas for Christ.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ