“Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.
Nor bi just to tear una klot, but make una heart show sey una don turn from sin kom meet mi.” Make una kom back kon meet di Oga wey bi una God. E dey kind and dey show mesi; E dey patient and dey keep en promise; E always dey ready to forgive and nor bi to ponish pipol.
I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.
Make una test unasef to know weda una still dey inside di faith; e good make una shek unasef well-well! Una nor know sey Christ dey inside una? May bi una don fail di test!