Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:53 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

53 I dey vex for wiked pipol, bikos dem rijet wetin Yu tok.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:53
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Den e get up from di temple front kon enter Jehohanan wey bi Eliashib pikin room. E dey der thru-out dat nite dey kry for di pipol sin. E nor chop or drink anytin.


So, how wi go forget yor kommand again kon go marry doz wiked pipol? If wi do am, Yu go vex kon distroy us finish and nobody go survive.


Wen I hear dis tins, I vex tear my klot, kut my hair and bear-bear kon sidan for groun dey mourn.


I kworel, curse, slap and pul di men hair. Den I make dem swear with God name sey dem and dia shidren nor go ever marry from anoda kountry.


I vex well-well wen I hear dia kry and komplain.


I dey kry like river wey dey flow, bikos pipol nor gri obey yor kommands.


Wen I si lie-lie pipol, e dey make mi sick, bikos dem nor kare about yor kommandment.


But if en shidren-shidren nor gri listin to my kommand and disobey my laws;


But as una nor gri listin, I dey kry for sekret, bikos of una pride; I go kry well-well till I nor fit kry again, bikos dem don karry God pipol go as slave.”


Den Daniel (wey en name na Belteshazzar) kon dey worry sotey e nor fit tok anytin. Di king kon tell am, “Belteshazzar, make yu nor let dis dream and en meaning worry yor mind.” Daniel ansa, “My king, e for betta sey dis dream na for yor enemy and wetin e mean, na for di pipol wey dey trobol yu!


I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.


I dey fear sey wen I kom again, God go disgrace mi for una front. And I go kry, bikos many of una still dey sin. Una neva turn from sin kom meet God; una neva turn komot from di ashawo and yeye life wey una dey live.


Bikos I don tell una before and I dey tok am again with tears for my eye sey, di way many pipol dey bihave, dey show sey dem bi enemies to Christ cross.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ