51 Na so-so laf wiked pipol dey laf mi, yet, I dey still obey yor laws.
Bikos I just dey waka follow God for back; for di road wey E choose by ensef and I nor dey waka on my own.
Many pipol dey trobol and wahala mi, yet I neva run or turn from yor laws.
Yu porshu sturbon pipol; doz wey nor dey obey yor kommand and bikos of dis, curse dey dia head.
I hold yor laws well, so my God, make Yu nor let shame katch mi!
Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.
Na only Yu dey awa heart and wi still dey follow yor ways.
“Oga God, make Yu remember sey I dey faithful and loyal as I dey serve Yu. I always dey do wetin Yu wont make I do.” Den e kon bigin kry well-well.
E nor go luz hope or start to fear. E go bring betta judgement kom evriwhere for di world and pipol for far-far land, dey wait make E kom tish dem.”
My God, Yu don deceive mi! Yu don deceive mi so dat I go bi yor profet? Yu strong pass mi and Yu get pawa well-well. Naw, evribody dey look and laf mi.
Di pipol still stand der dey look, but dia leaders dey laf Jesus sey, “E save oda pipol. Make e save ensef if e bi di Mezaya wey God choose!”