Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:50 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

50 Yor promise dey revive and help mi wen I dey for trobol.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:50
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I liedan dey roll for dust; so make Yu save mi with yor word.


Make Yu tell mi again about yor promise wey Yu make to di pipol wey dey fear and obey Yu.


My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail and di salvashon wey Yu promise mi.


If to sey yor laws nor keep mi with joy, I for don die with my pains.


Even doh trobol gada round mi, Yu still kom save mi. Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi and yor rite hand kon save mi.


But where I for dey naw, if to sey I nor bilive sey God go favor mi for dis land wey wi dey?


Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.


Wetin make mi nor get hope? Wetin make my heart nor dey happy at-all? But I go still put my hope for God hand! I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!


But evriday, God dey pour en love wey nor dey fail for my life and evry nite, I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.


Wen I dey fear sey evritin don finish for mi, Yu kon konfort, give mi new hope and make mi trust Yu.


My Oga God wey dey mighty, anytime Yu dey tok to mi, I dey listin well-well and na joy and happiness full my heart, bikos I bi yor own.


So I kon tok as God don tell mi. Life kon enter di body dem and dem kon stand up. Dem many well-well like sojas.


Na di Spirit go fit give pesin life; human being pawa nor fit do am. All dis word wey I dey tell una so, dem bi Spirit and dem dey give pesin life.


Bikos evritin wey dem rite from biginnin, na to tish, enkourage and give us hope.


As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.


Wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, for di mesi wey E dey show us. God give us new life thru Jesus Christ wey E wake from deat and naim bi di Pesin wey give us hope.


But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ