Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:47
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.


I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody, but I love yor kommandment.


Yu swip wiked pipol komot dis world like dirty; know wonder I dey love to obey yor laws!


True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.


I don test yor promise well-well kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem.


My God, make Yu si how I love yor kommands. Make Yu give mi back my life, bikos of yor love wey nor dey fail.


I go obey yor laws and I nor go forget yor word.


Pipol wey dey lie and go against yor word, I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok.


I dey obey yor laws, bikos I love dem well-well.


My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.


bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise.


I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.


My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday.


Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.


Since I dey do wetin I hate to do, e show sey di law dey korrect.


I dey like to obey God law with my whole mind,


bikos na wetin E koll yu to do, bi dat. Christ sofa as ezample wey una go follow


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ