Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:34 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

34 Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:34
26 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make di Oga wey bi yor God give yu wisdom to take rule Israel, just as E tok.


God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”


Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.


I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.


I even get sense pass my eldas, bikos I dey keep yor kommandment.


Yor kommandment don make mi undastand life well and na-im make mi hate to do bad tins.


I bi yor savant, so make Yu give mi sense, so dat I go undastand yor rules.


Di tishing for yor word dey give lite, so even pipol wey nor go skool dey undastand am.


Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.


My God, make Yu listin to my kry; make Yu give mi betta sense thru yor word!


Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.


I wont yor blessing with all my heart, so make Yu show mi mesi, just as Yu promise.


I bilive yor kommand and naw, make Yu tish mi how to judge well and to undastand yor laws!


Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.


Na Yu make and kreate mi. Naw, make Yu give mi di sense to follow yor kommand.


But even as I dey kwayet and nor tok wetin good or bad, my sorrow and pain still dey worse more-more.


So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.


“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.


Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.


So make una dey sure sey una dey do dem, bikos dis tins go show how una get sense rish among di pipol wey go hear am and dem go sey, “True-true, dis great kountry get pipol wey wise well-well.”


But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


My brodas and sistas, make una nor tok bad about each oda. Anybody wey tok bad or judge en broda or sista for Christ, e dey tok bad about di law and e dey judge di law. But if una judge di law, den una nor dey obey di law, but una don bikom di law judge bi dat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ