20 I always dey happy to dey learn yor rules and laws.
God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?
Joy dey for pipol wey dey do well and always dey do wetin dey rite.
I dey hongry for yor kommandment; I dey wait for yor laws.
My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well.
Oga, na Yu bi my God and e don tey wen I dey wait for Yu, bikos my soul dey hongry for Yu. My whole body dey hongry for Yu inside dis dry and pash-pash land wey nor get wota.
I really love to dey di kourt wey dey God temple. My heart and my whole body dey shaut for joy, bikos of God wey dey alive.
Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick, but dream wey kom to pass, bi like tree wey dey give life.
Betta friend dey always show en love and yor relashon go always dey with yu wen yu dey face wahala.
So Jerusalem wimen, make una promise mi sey: If una si my love, una go help mi tell am sey, en love don make mi dey sick.