Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:2
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

kon do evritin wey di Oga yor God kommand yu. Make yu obey en laws and kommand, just as Moses rite dem, so dat yu go prosper for evriwhere and anytin wey yu dey do.


Naw, make una serve God with all una heart and soul. Make una start to build di temple, so dat una go fit put di Kovenant Box and all di holy tins wey dem take dey serve God, for inside.”


Evritin wey e do to take serve God well for en temple and to follow God laws and kommands, Hezekaya do dem with e whole heart and bikos of dis, God kon make am prosper.


All dis tins happen make dem for dey follow God laws kon obey en kommand. So make wi praiz di Oga wey bi awa God!


I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.


I don decide sey I nor go do any bad tin, so dat I go always dey obey yor word.


Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die.


Make Yu save mi, bikos I dey kry to Yu make I for fit obey yor kommand.


Make Yu dey good to mi wey bi yor savant, so dat I go live and obey yor word.


So make Yu nor let dem laf and curse mi, bikos I dey obey yor kommand.


My God, make Yu tish mi yor laws and I go obey dem till I die.


Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.


Na Oga God dey guide and save mi! So I promise to always dey obey yor word!


Wiked pipol lie full my ear, but I dey obey yor kommands with all my heart.


So make Yu save my life with yor love wey nor dey fail; den I go kontinue to obey yor laws.


All doz wey dey keep God kommand and obey en laws, E dey show dem en faithfulnes kon lead dem with love wey nor dey fail.


My pikin, listin well-well and make my life bi ezample to yu.


Una go pray and woship mi with all una heart and I go dey with una.


I go give una my spirit kon make sure sey una dey follow my laws and keep all di kommandment wey I give una.


Jesus ansa am, “Anybody wey love mi, go do wetin I tok and my Papa go love am, den wi go kon meet and stay with am.


But if una turn to God from der, E go kom help una, dat na if una really turn kom meet am with all una heart and soul.


Make una make sure sey una dey obey dis kommand well kon keep all di laws wey E give una.


So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.


So, even if awa mind kondemn us, wi know sey God big pass awa mind and E know evritin.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ