yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.
Di priest work for di temple bi like wetin dey happen for heaven. Bikos wen Moses dey one build God house, God tell am: “Make sure sey evritin bi like di design wey I show yu on-top di mountin.”
So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.