Draw mi follow yu! Make wi kwik komot here! Make di king take mi go en room. Awa king, wi dey happy well-well, bikos of yu and wi like yor love pass wine. Yes, di yong wimen dey honor yu and dat na di rite tin to do.
I hear Israel pipol dey tok with pain sey, “Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train, but Yu don tish us to dey obey. So make Yu bring us kom back, bikos wi dey ready to kom meet Yu di Oga wey bi awa God.
My pipol bi like sheep wey waka lost. Who dey guide dem don make dem lost. Dem dey waka anyhow for di mountins; dey from one hill go anoda. Dem don forget dia place where rest dey.
“Doz wey don lost and wey waka anyhow, I go find and bring dem kom back. Doz wey get sore, I go bandage am for dem kon heal doz wey dey sick; but doz wey fat and strong, I go distroy dem, bikos I bi shepad wey dey do wetin dey rite.
My pipol don die finish bikos dem nor know mi. Since di priests don rijet mi, misef go rijet dem as my priests. Since una don forget una Oga God laws, misef go forget to bless una shidren.