175 Make I dey dis life, make yor laws kon help mi, so dat I go always dey praiz Yu.
Make Yu dey good to mi wey bi yor savant, so dat I go live and obey yor word.
My God, I know sey yor laws nor dey bad or hard. Yu dey ponish mi, bikos e dey good for mi.
“Wetin Yu go gain if I die? Wetin Yu go get if I enter grave? Dead body go fit praiz Yu?
Na pipol wey dey life fit praiz Yu, just as I dey praiz Yu naw. Papa dem dey tell dia shidren how Yu dey faithful rish.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.
And wi know sey evritin dey work for awa good, bikos wi love God and dey do wetin E wont.
Bikos di small trobol wey wi dey face naw, go bring glory wey big well-well, wey go last forever and wey betta pass anytin for dis world.