174 My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
My Oga God, I trust Yu sey, Yu go save mi!
Na so God go take bless my shidren-shidren, bikos E don make kovenant wey go last forever with mi: agriment wey nor dey break and promise wey nor dey shange. Na wetin go give mi viktory bi dat and God go make am happen.
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
I go obey yor laws and I nor go forget yor word.
Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.
bikos yor law dey sweet and dem dey give mi good advise.
My God, make Yu give mi yor love wey nor dey fail and di salvashon wey Yu promise mi.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
Wen wetin pesin hope for nor kwik rish en hand, di heart go sick, but dream wey kom to pass, bi like tree wey dey give life.
So Jerusalem wimen, make una promise mi sey: If una si my love, una go help mi tell am sey, en love don make mi dey sick.
Naw, I know wish one I go choose, bikos I won go dey with Christ and na dat one betta pass.