172 Make my tongue sing about yor word, bikos all yor kommandment dey rite.
All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
I dey shaut and tok about all di kommands wey Yu give us.
Yor rules dey pafet and wi go fit trust dem.
Yor judgement na forever and yor laws dey pafet and true.
I go speak to kings about yor laws and I nor go shame.
But all yor kommand dey good, so make Yu protet mi from di pipol wey just like to kill mi.
Doz wey dey fear God dey advise pipol well and dem dey tok wetin dey rite.
Wi nor go hide dis trut from awa shidren; wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do, en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us.
But di law dey holy, rite and good.
Wi know sey di law dey spiritual. But I bi human being and dem don sell mi give sin.
Make una nor allow any bad word kom out from una mout, but make una word dey give poor pipol hope, so dat e go bless pipol wey hear am.
and una must tish una shidren kon tok about am as una sidan for house; dey waka for road; dey sleep or wen una wake-up.
Make all of una word dey good and sweet like wetin dem put sugar, so dat una go know how to ansa evribody.