171 Make praiz dey always kom out from my mout, bikos Yu don tish mi yor laws.
As I dey learn evritin about yor raitiousness, I go tank Yu as I dey live my life as I suppose to live am!
But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”
My God, make Yu open my lips, so dat my mout go praiz Yu.
My God, na from wen I bi small pikin, Yu dey tish mi yor ways and I always dey tell pipol about di wonderful tins wey Yu don do.
So Oga God, make di pipol wey Yu dey ponish, happy. Doz wey Yu dey tish yor ways.