17 Make Yu dey good to mi wey bi yor savant, so dat I go live and obey yor word.
So my soul go rest again, bikos God dey good to mi.
My God, make Yu give mi life as Yu promise, so dat I nor go die!
I bi yor savant, so make Yu show mi yor love wey nor dey fail kon tish mi yor laws.
Make Yu kom show mi yor mesi, just as Yu dey do to evribody wey love yor name.
Yor laws always dey rite; so make Yu help mi undastand dem, so dat I nor go die.
Make I dey dis life, make yor laws kon help mi, so dat I go always dey praiz Yu.
Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.
My God, Yu don do many good tins for mi just as Yu promise!
Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
Yes! I go sing to God, bikos E don save mi.
Evribody for dis world don receive plenty good tins from am.
God kreate us thru Jesus Christ as di good work wey E don prepare down before, so dat wi go dey do as E plan.
My God go give una evritin wey una nid, bikos of en glory and propaty wey dey inside Jesus Christ.
If una know sey E dey raitious, den una go know sey, doz wey dey do wetin God wont, na en shidren dem bi.