166 My God, I dey wait since make Yu kom save mi and I dey obey yor kommand.
My Oga God, I trust Yu sey, Yu go save mi!
My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
Make yu offa sakrifice with di rite spirit give God kon trust am.
But to dey give tanks, na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body. So if una follow my kommand, I go show una how God salvashon bi.”
So e betta make wi sidan kwayet kon wait until God go kom save us.
Anybody wey ready to do wetin God wont, di pesin go know weda wetin I dey tish na from God or na my own.