Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:165 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

165 Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:165
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na to obey yor kommand bi evritin wey I dey do for dis life.


E go still make yor life sweet and yu go dey save.


Dem go make yu dey save for anytin wey yu dey do and yu nor go ever fall.


Oga God, Yu dey guide and save pipol wey dey faithful, bikos dem trust Yu.


So God word nor make sense at-all to dem and na dis go make dem fall wen dem try to waka. Yes! Dem go fall for trap kon wound and dia enemies go karry dem go as prisonas.


and bikos evribody dey do wetin dey rite, peace and sekurity go dey der forever.


God sey, “Klear di road! Klear di road! Make una remove di tins wey fit stop my pipol to turn back kom meet mi!


Wiked pipol nor go ever get peace of mind.” Dis na wetin God tok.


but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.


Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.


Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.


Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.


Pesin wey love en broda or sista for Christ, dey live inside di lite and nor-tin go make am fall.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ