163 Pipol wey dey lie and go against yor word, I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok.
I nor go allow pipol wey dey deceive odas, serve for my house and doz wey dey lie, nor go stay for my present.
Yor kommandment don make mi undastand life well and na-im make mi hate to do bad tins.
I hate pipol wey dey pritend sey dem dey loyal to evribody, but I love yor kommandment.
All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
Make Yu nor let mi dey deceive mysef; but make Yu allow mi know yor ways.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
Doz wey dey fear God nor like lie; but na only shame and disgrace wiked pipol dey kause.
Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.
Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.
Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.
Since una don stop to lie, make una start to tok trut give una neighbour, bikos all of us na membas for Christ body.
Pipol wey dey do like dogs, doz wey dey do majik and kill odas; doz wey dey serve juju and dey like to lie, all of dem nor go enter di town.