15 I go learn yor kommand kon study yor laws.
As evening dey rish, Isaak kon go di field go relax. Den e look kon si sey some kamel dey kom.
Instead, e dey always dey happy to obey God kommand and na both for day and nite, e dey study dem.
Make Yu keep mi and I go dey save; den I go always dey follow wetin Yu tok.
I dey hongry for yor kommandment; I dey wait for yor laws.
I nor dey sleep for nite, bikos I dey tink about yor promise.
Even doh important pipol sidan dey plan against mi, I go still dey tink of yor kommand,
I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.
den I nor go shame, bikos I dey follow wetin Yu tok.
Make Yu disgrace doz wiked pipol wey dey lie for my head; but I go always dey follow yor kommand.
My God, si as I love yor laws and I dey tink about dem evriday.
Yes, I get betta undastandin pass my tishas, bikos I always dey tink of yor laws.
But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.