149 So my God, make Yu hear my kry, bikos of yor love wey nor dey fail! Make Yu save mi as Yu dey always do.
My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
Make Yu kom fight and protet my life just as Yu promise.
My God, si as yor mesi great rish; so make yor laws dey give mi hope as I dey do dem.
I liedan dey roll for dust; so make Yu save mi with yor word.
I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well.
So make Yu save my life with yor love wey nor dey fail; den I go kontinue to obey yor laws.
My God, make Yu sorry for mi, bikos of yor love where nor dey fail. Make Yu forgive mi my sins, bikos Yu dey sorry for pipol.
Abeg, make Yu listin kon ansa mi, bikos di trobol wey dey face mi, too mush.
My God, make Yu listin to mi as I dey komplain! Make Yu protet my life from all di wiked attack wey di enemies dey plan.
My God, make Yu ansa mi, bikos yor love wey nor dey fail, dey good and bikos of how Yu dey sorry for pipol, make Yu turn face mi!
I go tok about God love wey nor dey fail. I dey praiz am for wetin E don do for us. E don bless Israel pipol well-well, bikos of en mesi and love wey nor dey fade.