147 I dey wake-up before day break well and yor words dey give mi hope.
Jita and trumpet, make una wake-up! I go wake-up for early morning kon praiz Yu with song from my mout.
Make Yu nor take yor word komot from my mout, bikos na yor law dey give mi hope!
Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
Na suksess and progress Yu take welkom am back kon put one fine gold crown for en head.
But evriday, God dey pour en love wey nor dey fail for my life and evry nite, I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.
Make Yu listin to my vois for morning, bikos evry morning, I dey kom meet Yu and dey wait with patient make Yu ansa mi.
I praiz God for wetin E don promise. I trust God, so wetin go make mi dey fear?
So, make my heart wake-up! Trumpet and jita, make una wake-up too! Mi mysef go wake-up for morning with song for my mout.
My God, I dey kry give Yu and I go kontinue to beg Yu evriday by day.
Abeg, make Yu hear my prayer; make Yu listin to mi as I dey kry,
I look for Yu for nite, my spirit dey find Yu for morning, bikos wen Yu start to judge di world, den pipol for dis world go know and learn how to bihave well.
For early morning wen evriwhere still dark, Jesus leave di house go one kwayet place go pray.