145 My God, make Yu ansa mi, bikos I dey pray with all my heart, so dat I go always dey obey yor laws.
My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!
I don try well-well to find Yu. Abeg, make Yu nor let mi go against yor kommand.
I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment.
Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die.
Den I go always dey obey yor laws forever and ever.
I wont yor blessing with all my heart, so make Yu show mi mesi, just as Yu promise.
I go obey yor laws, so my Oga God, make Yu nor taya for mi!
My pipol, make una always dey trust God, bikos na en dey guide us.
My God, make Yu make mi happy, bikos I don give mysef to Yu.
Una go pray and woship mi with all una heart and I go dey with una.
Hannah nor dey happy as e dey pray give God, so e kon dey kry.
But Hannah ansa, “My oga! Nor bi as yu tink am! My mind nor setol at-all. I nor drink as yu dey tink o-o. I just dey tell God evritin wey dey my heart.