140 I don test yor promise well-well kon si sey dem dey pure and dat na why I always dey love dem.
All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
God promise dey pure well-well like silva wey dem melt for fire.
So Oga God, wi know sey Yu go protet doz wey dem dey opress. Yu go guide dem forever from doz pipol wey sabi lie well-well,
God ways dey pafet and all en promise na true. E dey guide evribody wey kom make E protet am.
God kommands dey rite and e dey put joy for pesin heart. En kommands dey klear and e dey give pesin hope to stay for dis world.
“Evritin wey God tok, dey korrect. E dey guide evribody wey kom meet am make E protet dem.
But di law dey holy, rite and good.
Since I dey do wetin I hate to do, e show sey di law dey korrect.
I dey like to obey God law with my whole mind,
But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well
bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.