14 Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
I dey always do wetin E tok; dey follow en words; nor bi my own.
Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.
Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont
True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.
Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.
Make Yu sorry for mi kon protet mi, so dat I nor go die, bikos na yor law dey make belle sweet mi.
My Oga God wey dey mighty, anytime Yu dey tok to mi, I dey listin well-well and na joy and happiness full my heart, bikos I bi yor own.
“God Kingdom bi like gold wey dem beri for field. One pesin wey si am, kon hide am. With happiness, e go sell evritin wey e get buy di land.