131 I dey hongry for yor kommandment; I dey wait for yor laws.
Evribody dey welkom mi, just as farmer dey welkom rain wey won fall.
Like savant wey dey wait make nite kwik kom; like worker wey dey wait make dem pay am.
Like pesin wey si many propaty karry for war, na so too I dey happy to hear yor word.
My God, e don tey wen I dey wait make Yu kom save mi, bikos na yor laws dey give mi hope.
I always dey happy to dey learn yor rules and laws.
I dey wait since to obey yor kommand, so make Yu make my life new again, bikos Yu good well-well.
My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.
Bikos na mi wey bi una Oga God, save una from Egypt land. Make una open una mout wide and I go pak good tins full am.
Make una try to live for peace with evribody and dey holy, bikos anybody wey nor dey holy, nor go si God.
But make una dey hongry for spiritual milk like pikin wey dem just born, so dat una faith go strong well-well