127 True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.
Just as I dey happy to get propaty, na so too I dey happy to obey di laws wey Yu give us.
Naw, make Yu si as I dey happy to obey yor kommand! Si as I love dem well-well!
Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.
Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well. Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.
E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.
Na mi bi wisdom; I betta pass gold; nor-tin una wont wey good each mi.
Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.