Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:125 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

125 I bi yor savant, so make Yu give mi sense, so dat I go undastand yor rules.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:125
16 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat.


I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu.


Make Yu nor let mi dey deceive mysef; but make Yu allow mi know yor ways.


Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.


I bilive yor kommand and naw, make Yu tish mi how to judge well and to undastand yor laws!


I bi yor own, so make Yu save mi, bikos I don work well-well to obey yor kommand.


Make Yu turn face mi kon sorry for mi! Make Yu give yor pawa to yor savant, den diliver pipol wey dey obey Yu.


Wise pipol know where dem dey go, but foolish pipol dey deceive demsef.


If yu won get wisdom, yu go first fear God. If yu know di One wey dey holy, den yu don get undastandin.


But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end.


Make yu tink about wetin I dey tok so and Christ go help yu to undastand evritin.


But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ