Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:120 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

120 I dey shake bikos I dey fear Yu and yor kommandments and rules dey make mi sopraiz.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:120
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Wen di king hear di laws wey dey di book, e kon tear en klot.


From Mushi family, di leaders na Mahli, Eda and Jerimot. All dis na leaders for Levi family.


“Make una go pray give God for mi and di pipol wey remain for Judah and Israel. Den ask am about di words wey dey dis book wey dem si, bikos God dey vex for us, bikos awa grand-grand papa nor obey en word as dem rite am for dis book!”


and yu kom turn from sin kom meet mi, as yu tear yor klot dey kry wen yu hear sey I won ponish Jerusalem with en pipol. I don hear una prayer.


Na dis make mi dey fear and wen ever I si am, my hold body go dey shake.


But bikos I dey fear God ponishment, I nor fit do dat kind tin.


I dey vex for wiked pipol, bikos dem rijet wetin Yu tok.


Di way Yu dey vex, dey make mi sopraiz. Yes! Yor vexnashon don distroy mi finish.


Na my hand I take make heaven and eart; dem with evritin wey dey inside na my own. Mi wey bi Oga God, don tok! I go bless di pesin wey dey honbol and dey ready to turn from sin kom meet mi; pesin wey dey fear and obey mi.


Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.


I fear well-well wen I hear all dis tins and my lips kon dey shake. Fear and kold katch mi at wons. I go really wait for di time wen God go ponish doz wey dey attack us.


So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well,


Wetin happen dey make pesin fear, so Moses kon sey, “I dey fear and dey shake.”


Di pipol wey dey stay Bet-Shemesh kon ask, “Na who go fit stand before di Oga awa God wey dey holy? Na where wi won send di box go, so dat God go leave us?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ