117 Make Yu keep mi and I go dey save; den I go always dey follow wetin Yu tok.
I honor and love yor kommand and I dey always tink of yor laws.
den I nor go shame, bikos I dey follow wetin Yu tok.
yor hand go guide mi for der and yor rite hand go support mi.
Na only yor ways I dey follow; I neva stop to follow Yu.
I dey follow all en rules and I neva ever rijet en laws.
Yes! Yu don dey with mi since wen dem born mi and Yu dey kare for mi from my mama belle. No wonder I dey always praiz Yu!
Yet, I still bilong to Yu and Yu hold my rite hand.
Na mi bi di Oga wey bi una God and I dey enkourage una sey, ‘Make una nor fear, bikos I go help una.’ ”
Wish rite yu get to kondemn anoda pesin savant? Na only dia oga fit tok weda dem dey do well and e must make sure sey, dem do di rite tin.
and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.
Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.