Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 119:115 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

115 Una wey bi sey na wiked and evil tins full una mind, make una komot from my life; bikos na my God kommandment I go obey till I die.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 119:115
10 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I don first promise and I dey promise again sey; I go always dey obey all yor kommandment.


Pipol wey dey follow en rules kon find am with all dia heart, make una si as dia blessing many rish.


My God, I wish sey Yu go just kill wiked pipol finish! So make wiked pipol leave mi alone o-o!


I hate to dey where bad pipol dey and I nor go ever follow wiked pipol waka.


Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol.


All of una wey dey do bad tins, make una leave mi alone, bikos God don hear my kry.


“Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.


Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”


Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.”


If una sey una nor won woship God, den today-today, make una choose who una go woship, weda na una grand-grand papa gods wey dey di oda side for di river, or Amor pipol gods wey dey di land wey una dey stay so. But for mi and my whole house, na di Oga awa God wi go woship and serve till wi die!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ