114 Na Yu bi my proteshon and guide and na yor word dey give mi hope.
Make Yu nor take yor word komot from my mout, bikos na yor law dey give mi hope!
Make pipol wey dey fear Yu, dey happy wen dem si wetin Yu do for mi, bikos I don put my hope for yor word.
I taya as I dey wait make Yu save mi, but I don put my hope for yor word.
But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.
Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.
Na God bi di place where I dey hide put and E dey protet mi from trobol. God surround mi with song and happiness from doz wey E diliver.
Oga God na awa sun and naim dey protet us. God dey give us grace and glory and E go always dey good to doz wey dey do good.
Dem go bi like house wey pesin hide put bikos of heavy rain. Dem go bi like wota wey dey rush for desert; like big rock wey en shadow kover empty land.