104 Yor kommandment don make mi undastand life well and na-im make mi hate to do bad tins.
Nor bi old age go make pesin wise or tish pipol how to undastand wetin dey rite.
I nor go even tink to do bad tin and I nor go join pipol do bad tins.
I even get sense pass my eldas, bikos I dey keep yor kommandment.
All yor kommands dey korrect and dat na di rizin why I hate to do bad tins.
Pipol wey dey lie and go against yor word, I hate dem well-well, bikos I love evritin wey Yu tok.
Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.
Yor kommandment make mi get sense pass my enemies, bikos na dem dey always guide mi.
Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.
Una wey love God, make una hate bad tins! God dey protet pipol wey dey fear am kon save dem from wiked pipol pawa.
Wetin pesin dey do fit dey korrect for en eye, but e dey lead am to en grave.
If to sey una dey fear God, den una go hate bad tins. I hate pride, pipol wey dey tok anyhow, bad-bad tins and lie-lie words.
Make una hate bad tins kon love to do good, den dey judge well for kourt. May bi God go sorry for di pipol wey still remain for dis land.
“Make yu pass di small gate enter, bikos di gate wey pipol go pass go sofa, wide well-well and many pipol dey waka enter.
Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.