100 I even get sense pass my eldas, bikos I dey keep yor kommandment.
Old pipol get wisdom? Abi long life nor dey bring undastandin?
God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
Bikos na Elihu small pass for der, e wait until evribody tok finish.
Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.
Make Yu make mi undastand and I go obey evritin wey Yu tok kon learn dem with all my heart.
“Pesin wey hear my word and do wetin I tok, e bi like wise man wey build en house on-top rock.
Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.