Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 118:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Di Oga na God, so make wi start di celebrashon with sakrifice, as wi dey mash round di altar with bambo leaf for awa hand.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 118:27
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Elijah kon tell di pipol, “Na how e go tey rish before una go know wetin una suppose do? If God na di korrect God, den make una follow am! But if na Baal korrect, make una follow am too!” But di pipol nor tok anytin.


Wen di pipol si dis tin, dem fall face groun kon dey sey, “Na God bi di true God! Na God bi di true God!”


Di next day, dem kon dedikate and sakrifice some animals to God, den dem give dem to di pipol make dem chop. Dem still sakrifice 1,000 rams, bulls and lamb for di altar kon still bring wine as ofrin.


Jew pipol kon dey happy well-well and belle sweet dem.


Yu lite one lamp for mi. Na di Oga my God put lite for my darkness.


E go show sey yu dey innocent kon defend yu for publik.


Den yu go make four horn for en four korna; di horns go bi part of am. Yu go take bronze kover am.


E make horn for en four kornas; di horns na part of am. And e kover dem with bronze.


Jerusalem pipol, make una raiz and shine like sun, bikos God glory dey shine on-top una!


Pipol wey dey waka for darkness don si lite. Lite dey shine for doz wey dey stay for di land where strong darkness dey.


I go dey patient as God dey ponish mi, bikos I don sin against am. But afta E don ponish mi, E go fight for mi kon make mi win. God go take mi enter di lite and I go si en raitiousness.


But for una wey dey fear my name, my sun wey dey give life go shine and heal una. Una go dey free kon dey happy like melu pikin wey dem open en kage make e for go play.


Den Jesus sey, “Na mi bi di lite wey dey di world, anybody wey follow mi, nor go waka for darkness lie-lie, but e go get di lite wey go gi-am life.”


True Christ, make wi kontinue to dey give God praiz as awa sakrifice. So, make wetin dey kom out from awa mout bi, “Na Jesus, bi Oga God.”


But God don choose una to bi en priest and holy pipol, so dat una go prish di Good News, bikos E koll una from darkness kon enter en brite lite.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ