Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 118:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Na songs for joy and viktory dem dey sing for di kamp of pipol wey dey fear and obey God, bikos God don do wonderful tins with en strong rite hand!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 118:15
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.


Na yor laws bi my special propaty; na dem my heart wont


Anywhere wey I dey, na yor law bi di song wey I dey sing.


So, doz of una wey get pure heart and dey raitious, make una happy well-well!


Dem nor win di land with dia swod and nor bi dia own strong hand make dem win, but na yor rite and strong hand with di shinin-shinin lite from yor face, help dem, bikos Yu love dem.


Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good. Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.


My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu. Yu dey always protet dem well-well, bikos of yor favor wey nor dey end.


But with awa God help, wi go get viktory, bikos E go help us mash awa enemies for groun kon win dem.


But pipol wey dey fear God go dey happy; dem dey happy for God present and dia joy nor dey end.


Pawa dey yor hand; yor hand strong well-well! Wons Yu raiz yor rite hand wey get pawa, Yu dey always dey win.


Make una sing new song for God, bikos E don do wonderful tins! E dey diliver pipol with en rite and strong hand.


My Oga God, yor rite hand get betta pawa and e skata di enemies to pieces.


I dey tell una sey, doz wey woship and obey mi, go get plenty food to chop and drink, but food and wota go hongry una wey dey disobey mi. My pipol go dey happy, but na disgrace go follow doz wey dey disobey mi.


E don do many big-big tins with en pawa and E don skata di mind of di pipol dey karry body up.


Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop. E happy well-well sey en and en family don bilive God.


For der, una must celebrate for di Oga una God present, with all una shidren, savants and Levi shidren wey dey stay una town, (bikos dem nor get land or propaty among una).


Evribody wey dey heaven, God pipol, di apostles and profets, make una happy bikos God don judge and kondemn am bikos of una!”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ