Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Psalms 117:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Bikos E love us with di love wey nor dey fail and God goodness dey last forever. So make una praiz God!

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Psalms 117:2
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish.


Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem. E dey keep all di promise wey E make.


Love wey nor dey fail and trut, don join togeda. Raitiousness and peace don kiss each oda.


I go always dey sing about God love wey nor dey fail! Both yong and old pipol go hear about how God good rish.


Oga God, na Yu bi my God! I go praiz yor name kon show as Yu good rish, bikos Yu don do wonderful tins and na as Yu tok before-before, na so Yu do am.


Just as Yu promise awa grand-grand papa, Abraham and Jakob, na so too Yu go show us yor faithfulnes and love wey nor dey fail.


Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.


Na Jesus Christ kom dis world with wota and blood. Nor bi only with wota, but na with di wota and di blood. And God Spirit bear witness sey dis na true, bikos na God Spirit bi di trut.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ